Celebration everywhere as NFF announce Bruno Labbadia as di new Super Eagles coach.

Di 58- year old na former Bayer Munich striker and dem born am for Germany so oga Bruno Labbadia carry tiktak and winning mentality dey come Super Eagles.

Wetin di sweet me for where oga Bruno Labbadia dey be say na better coach wey sabi geh geh pressing and e get better plans.

Bruno Labbadia don coach nine clubs for Germany ( clubs like Hertha Berlin,VfB Stuttgart, VfL Wolfsburg, Hamburger SV, Bayer Leverkuse) and e no dey stay pass one year for those 9 clubs before dem go sack am.

Di only time wey oga Bruno coach team pass 3 years na from 2010-2013 and di name of di club na Stuttgart, so di club later appoint am back in December 2022 come later sack am in April 2023 because e nearly carry them enter relegation( na 3rd to last them finish for table that season).

I believe say e go do well for Super Eagles abeg make una welcome am.

image